Saturday 18 May 2013

Girls!!! Girls!!! Girls!!! AFTER GOD, FEAR GIRLS No be today wey SOME African Ladies don dey lie, e don tey well well. Their lies dey turn belle, but e get one particular system of lying wey dey make my head scatter. Person go update her status,like "I Love You"....wen you ask her who she dey love, she go say na Jesus Christ she dey Love. Okay, no wahala. Another girl go update her status like, "I miss my baby so much".....if you ask am who be her baby, she go say na Jesus. Hmmmmm, una don see how some girls dey call Jesus baby ba? Some go write "I can't breathe without you"..... and dem go say na Jesus dem dey talk about. Even wen people wey no believe in Jesus dey breathe well well everyday, people like Brad Pitt. Fat fat lies. The one wey dey pain me na when some ladies update their status like "I miss you baby, I wanna be in your arms".....and them go say na Jesus dem dey miss. Haba, wich kind thing be dis fa. So na Jesus arms dey hungry you shey??? Make una stop dis tin abeg. Hmmmm, the drama no stop there oooo, their boyfriends and assistant boyfriends go go their inbox to find out weda na dem she dey talk about. Come see lies na, she go twist their heads and use reverse psychology take finish them. Come see wetin she go yarn; "so Michael you don't believe me, it is you am referring to in that status and I must not put your name to prove my love for you. If you don't believe me, fine, I won't kill myself" O boy, with dis line, the girl go kill their moral and na the boys go come begin dey beg her. The girl go come dey form vexing tins and in order to cool her down, some of the jonzing boys go wire some money enter her account or buy her big recharge cards.... see hammer na...Chai, fear some African girls, walahi. So any time una see some African girls dey update their status like dat, make una bone dem. They are still learning.....lo ­ ­lz Kai, African girls, I hail oooo... I dey feel una die..

No comments:

Post a Comment